Lyric video
Watch on YouTube ↗Jaja jaja jaja jaja jaja
Papa Papa Mama don pack cloth run ooo
Maro come
Bome hold your sister
Ejiro stop to cry
Daddy dey here
Mm
I just dey back from hustle
My wife done run
Who I go blame?
Na so we go dey dey?
Upon all the "yes sir," "yes sir."
Na 10k dey my hand
Who I go blame?
Now so we go dey dey?
10k na all I get
27-year-old man
E no reach for food
E no reach for light
My pikin dey soak garri
Hunger dey waya me
Who I go blame?
Now so me go dey dey?
Every day, the same thing
Every night, we soak garri
Every morning, we drink water, afternoon nko?
Hunger wan kill us!
Na so we go dey dey?
I be man, but I know get shi shi
God, I dey ask you
Na so? Tinubu,
Na so we go dey dey?
Na so we go dey dey?
Mmm, your mama don run
Your mama don go
Na so Ejiro dey cry
Say breast milk don waka
I dey boil water
No rice to put inside
No beans to put inside. God abeg
(Na so we go dey dey?)
I get degree, I carry 2:1
But I no get shi shi
(Na so we go dey dey?)
I no be lazy youth. I dey hustle everyday
Abi make I go thief?
Me self, I don tire. Make me sef
run leave my pikin?
God abeg oooo
Government abeg!
Na so we go dey dey?
Na so we go dey dey?
Every day, the same thing
Every night, we soak garri
Every morning, we drink water
Afternoon nko?
Hunger wan kill us!
Na so we go dey dey?
I be man, but I no get shi shi
God, I dey ask you... na so?
Tinubu, na so we go dey dey?
Maro
Come close
Bome,
hug your sister
Tomorrow...
Maybe tomorrow I go see
work wey pay
But tonight...
We go soak garri
We go chop ekpa
Our belle go full well well
We go thank
Baba God
But God...
Hmm...
(Na so we go dey dey?)
Na so? Na so? ooooh
Credits
℗ 2026 Favour Usifo
Proof-of-release certificate →More from fav.ai
See all →Nothing playing